JỌN CHAPTA 3

 

 Jizọs Tọk Wit Nikọdimọs

(Vas 1-21)

1. Wọn man bin dee wee im nem na Nikọdimọs. Im bi big man fọ Judia pipul an im dee fọ Farisii grup. 

2. Dis man bin kọm to Jizọs fọ nait an im tẹl Jizọs see, "Ticha, wi no see Yu bi ticha wee Gọd dọn sẹnd, bikọs no pẹsin fit du dis kain mirakul-dẹm wee Yu de du ẹsẹpt Gọd dee wit di pẹsin."

3. Jizọs ansa am see, "A de tẹl yu tru see, no pẹsin fit sii Gọd Im Kindọm ẹsept dẹm bọn di pẹsin agen."

4. Nikọdimọs aks Am see, "Na hau dẹm fit bọn pẹsin agen wẹn di pẹsin dọn old? Abi im go fit ẹnta im mama bẹlẹ fọ sẹkọnd taim mek dẹm bọn am agen?"

5. Jizọs ansa am see, "A de tẹl yu tru see, ẹsẹpt dẹm bọn pẹsin wit wọta an di Holi Spirit, im no fit ẹnta Gọd Im Kindọm.

6. Pẹsin wee human papa an mama bọn, na human bin, bọt pẹsin wee Holi Spirit bọn na spirit.

7. Mek i no sọpraiz yu bikọs A tẹl yu see dẹm mọst to bọn una agen.

8. Wind de blo pas wia i want, yu de hia di nọiz wee i de mek, bọt yu nọ no wia i frọm kọm ọọ wia i de go. Na so i bi wit ẹvriwọn wee Holi Spirit dọn bọn."

9. Nikọdimọs kọm aks Am see, "Na hau dis kain tin fit hapun?"

10. Jizọs ansa am see, "Yu bi big ticha fọ Izrẹl an yu nọ no dis tins?

11. A de tẹl yu tru see, wi de tọk abaut wetin wi no, an de tẹl una wetin wi dọn sii, bọt una no biliv awa mẹsej.

12. If A dọn tẹl una abaut tins wee de hapun fọ dis wọld an una no biliv Mi, na hau una go biliv Mi if A tẹl una abaut tins wee de hapun fọ hẹvun?

13. An nobọdi dọn ẹva go ọp fọ hẹvun if nọ bi Man im Pikin wee kọm daun frọm hẹvun.

14. Jọs as Mosis put di snek fọ stik an kari am ọp fọ dẹzat, na so dẹm mọst to kari Man im Pikin put fọ ọp,

15. so dat ẹvri pẹsin wee put im trọst fọ Am go gẹt laif wee nọ go ẹva ẹnd.

16. Gọd laik pipul fọ wọld wẹl wẹl, na im mek Am giv Im ọnli Sọn, so dat ẹvri pẹsin wee put im trọst fọ Gọd Im Sọn nọ go dai, bọt go gẹt laif wee nọ go ẹva ẹnd.

17. Gọd no sẹnd Im Sọn fọ wọld so dat Im Sọn go kọndẹm pipul fọ wọld, bọt so dat Im go sev dẹm.

18. Gọd nọ go kọndẹm pẹsin wee put im trọst fọ Im Sọn. Bọt Im dọn ọlrẹdi kọndẹm di pẹsin wee no put im trọst fọ Am, bikọs di pẹsin no put im trọst fọ Gọd Im onli Sọn.

19. Dis na hau Gọd de jọj pipul fọ wọld: di lait dọn kọm insaid wọld, bọt pipul laik daknẹs pas ọf lait, bikọs dẹm de soso du bad tins. 

20. Eniwọn wee de du bad tins het di lait an im nọ go kọm to di lait, bikọs im no want mek di lait sho pipul di bad tins wee im de du.

21. Bọt eniwọn wee de du wetin Gọd tọk see bi tru tin de kọm to di lait so dat di lait go sho ẹvribọdi see di tin wee di pẹsin dọn du kọm frọm Gọd."

Jọn Wee De Baptaiz Pipul Tọk Abaut Jizọs

(Vas 22-30)

22. Afta dis, Jizọs an di pipul wee de lẹn an fọlo Im wee kọm go Judia Stet. Im dee dia fọ sọmtaim wit dẹm de baptaiz pipul.


23. Jọn tuu bin de baptaiz pipul fọ Ainon wee dee nia Salim, bikọs plẹnti wọta bin dee dia. Pipul bin de kọm to Jọn, an im bin de baptaiz


24. Dis na bifọ dẹm put Jọn fọ prizin.dẹm.


25. Sọm ọf di pipul wee de lẹn an fọlo Jọn im wee kọm stat to de agiu wit wọn Judia pẹsin abaut di kọrẹkt wee fọ pẹsin to wọsh im bọdi fọ dẹm rilijọn wee.

26. Na im dẹm kọm go to Jọn an tẹl am see, "Ticha, sii-oo, dat man wee bin dee wit yu fọ di ọda said ọf Riva Jọdan, di wọn wee Yu tọk abaut Am, Im de baptaiz pipul, an ẹvriwọn de go to Am."

Na im dẹm kọm to Jọn an tẹl am see, "Ticha, di man wee dee wit yu fọ di ọda said ọf Riva Jọdan, di wọn wee yu de tọk abaut Am, sii, ẹẹ, Im de du baptizim an plẹnti pipul de go to Am."

27. Jọn kọm ansa see, "No pẹsin fit gẹt enitin ẹsẹpt Gọd giv am to am.

28. Unasẹf hia wẹn a tọk see, 'Mi masẹf nọ bi di Kraist, bọt see Gọd sẹnd mi mek a kọm bifọ Kraist.'

29. Na di man wee de mari wuman niu na im gẹt di wuman. Bọt di frẹn fọ di man wee de mari wuman niu de stand fọ kọna an de lisin, an wẹn im hia di man vọis, bẹlẹ de swiit am wẹl wẹl. Bikọs ọf dis Man wee una de tọk ọf Am so, ma bẹlẹ de swiit mi gọọn. 

30. Im mọst to dee impọtant de go ọp ọp, bọt mi a go de go daun daun.

 

 Di Wọn Wee Kọm Frọm Hẹvun Pas Ẹvribọdi

(Vas 31-36)


31. Di Wọn wee kọm frọm hẹvun pas ẹvribọdi. Di wọn wee frọm dis wọld bi pẹsin fọ dis wọld an im de tọk abaut wọld tins, bọt di Wọn wee kọm frọm pas ẹvribọdi.

32. Im de tọk abaut wetin Im dọn sii an dọn hia, bọt nobọdi de biliv wetin Im de tọk.

33. Bọt eniwọn wee biliv wetin Im de tọk de grii see wetin Gọd dọn tọk na tru. 

34. Di pẹsin wee Gọd sẹnd de tọk Gọd Im tọk, bikọs Gọd nọ de tait hand to giv Am Im Spirit.

35. Papa Gọd laik Im Sọn, an Im dọn put ọl tins fọ Im hand.

 

36. Enibọdi wee put im trọst fọ Gọd Im Sọn dọn gẹt laif wee nọ de ẹva ẹnd. Bọt enibọdi wee nọ de du wetin Gọd Im Sọn tọk, dat pẹsin nọ go sii kọrẹkt laif. Gọd Im pọnishmẹnt go rimen fọ di pẹsin hẹd."

 

 

Go fọ:

Jọn: [Chapta 1] [Chapta 2] [Chapta 3] [Chapta 4] [Chapta 5]

[Chapta 6] [Chapta 7] [Chapta 8] [Chapta 9] [Chapta 10]

[Chapta 11] [Chapta 12] [Chapta 13] [Chapta 14] [Chapta 15]

[Chapta 16] [Chapta 17] [Chapta 18] [Chapta 19] [Chapta 20]

[Chapta 21]

Go f Di Bta Nius Abaut Jizs Kraist as Jn Tek Rait Am

Go bak fọ di Hom pej wee bi di Fẹst Pej fọ dis Websait

 

 
Make a Free Website with Yola.