Shọt Tọk Abaut Di Bẹta Nius Wee Spẹshal Mẹsẹnja Jọn Rait Abaut Jizọs Kraist



Abi Dis Na Di Fest Taim Wee Yu Want Stat To De Rid Gọd-Im-Holi Buk?

If na yọ fẹst taim, dẹn yu dee fọ kọrẹkt ples. Wi de advais yu mek yu stat bai to rid di Beta Nius abaut Jizọs Kraist as Spẹshal Mẹsẹnja Jọn tek rait am.

Dis na bikọs di Bẹta Nius as Jọn tek rait am bi buk wee bi di hat ọf Gọd-Im-Holi-Buk gọọn.

Abaut Di Beta Nius Abaut Jizọs Kraist as Jọn Tek Rait Am

Dis Bẹta Nius de tẹl ọs see Jizọs na Gọd Im Sọn. Gọd sẹnd Am kọm fọ wọld so dat Im (Jizọs Kraist) go sev ọs kọmọt fọ di bad an nyama nyama tins wee wi dọn du an wee wi dee insaid am. Na im mek Jọn rait fọ insaid dis im buk see, “... a dọn rait dis wọn so dat una go biliv see Jizọs bi di Kraist, an Im bi Gọd Im Sọn. An so dat bai to de trọst Am, una go gẹt laif.” - Jọn 21:31


Jizọs Gẹt Plnti Pawa Gọọn

Jọn stat di buk bai to tọk see Jizọs na Gọd Im Wọd wee dee alaif fọeva an ẹva.


An to pruv see na Gọd sẹnd Jizọs, Jizọs du plẹnti kain bai kain mirakul-dẹm. Im mek plẹnti plẹnti sik pipul to bikọm wẹl, Im rez ọp pipul frọm dai, an Im du wọndaful mirakul wia im tek faif brẹd an tuu fish tek giv 5000 pipul chọp. Di pipul chọp di chọp sotee ọl ọf dẹm bẹlẹful an plẹnti pisis ọf di chọp rimen.  


Nọ Bi Ẹvribọdi Put Im Trọst Fọ Jizọs

No mata see Jizọs du ọl dis wọndaful tins, nọ bi ọl pipul put dẹm trọst fọ Am. Sọm trọst Am, bọt sọm no ivun want tek ai sii Am.

Fọ insaid di pipul wee put dẹm trọst fọ Am, Jizọs chuz tuwẹf pipul an Im mek dẹm Im spẹshal mẹsẹnja-dẹm. Im tich dẹm plẹnti tins, Im giv dẹm plẹnti pawa to du mirakul, an Im bin dee tait wit dẹm gọọn.

Fọ nia di ẹnd ọf di tin Jọn rait abaut Jizos, wi go sii as bad pipul tek kach Jizọs an dẹm kil Am bai to nel Am fọ krọs. Bọt afta trii dee Im raiz ọp frọm dai an di pipul wee de lẹn an fọlo Im wee sii Am.


Wọn impotant tin wee wi want tọk bifọ wi land insaid wia yu go stat to de rid Di Bẹta Nius as Jọn rait am bi sọmtim wee Jizọz tọk. Im tọk see,


“A de tẹl yu tru see, no pẹsin fit sii Gọd Im Kindọm ẹsept dẹm bọn di pẹsin agen.” Jọn 3:3.


An Im tọk agen see,


“A de tẹl yu tru see, ẹsẹpt dẹm bọn pẹsin wit wọta an di Holi Spirit, im no fit ẹnta Gọd Im Kindọm.” - Jọn 3:5.


Dis na impọtant tọk wee go disaid wia pẹsin go go wẹn im dai, an wia im go liv im laif fọẹva an ẹva.


So na taim fọ yu to stat to de rid Di Beta Nius Abaut Jizọs Kraist as Jọn Tek Rait Am.


Dis Na Awa Preya F Yu

As yu de rid am de go, wi de pree mek Gọd opun yọ hat to risiv an ọndastan Im Wọd. Mek Im hẹlp yu to tẹk Im wọd du bẹta tins wee go hẹlp yu an ọda pipul fọ dis laif. An mek Im yuz Im Wọd tek pripia yu fọ ẹnta insaid laif wee nọ de ẹva ẹnd.


Impọtant: Fọ ọnda, yu go sii wia yu go prẹs so do dat yu go  go wia yu go rid eni Chapta fọ Jọn wee yu want rid:

Jọn: [Chapta 1] [Chapta 2] [Chapta 3] [Chapta 4] [Chapta 5]

[Chapta 6] [Chapta 7] [Chapta 8] [Chapta 9] [Chapta 10]

[Chapta 11] [Chapta 12] [Chapta 13] [Chapta 14] [Chapta 15]

[Chapta 16] [Chapta 17] [Chapta 18] [Chapta 19] [Chapta 20]

[Chapta 21]

Prẹs Hia, an yu go go bak fọ Fẹst Pej fọ dis Websait

 

 
Make a Free Website with Yola.